Enjoy Psalm 23 in Pidgin English (Naija way):

1. The Lord na my  shepherd, I dey kampe.
2. E make me sidon for where better dey flow yanfu yanfu. And come put me next to stream make my body thermocool.
3. E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness because of Hin name.
4. Walaii! If I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, liver no go fail me. Your rod and staff nko?
Na so dem dey like backbone dey comfort me.
5. You don arrange good fufu and Amala on top table make I chop. See bad belle people dey look waa waa. You rub me for head with vaseline intensive lotion. My cup come be like River Niger dey troway dey go.
6. True true, better life and mercy go dey follow me till I quench. And I go tanda for God house... lai lai I no go comot for wia better dey.
God Almighty, Na you
biko! AMEN!!!

Share on Google Plus

About King Angela Uyi

I am Angela Uyi aka Mama Naija|Two time Social Media Personality Winner| A smooth talker| Humanitaria| Ghost Writer| CopyWriter |Twitter:@Angelauyi |
    Blogger Comment
    Facebook Comment

0 comments:

Post a Comment

All content except noted photos and videos copyright © 2023, King Angela Uyi Creations.
All rights reserved. *Any images or videos not listed as mine are copyright to their respective owners and were used under creative common license or fair use standards. IF A PHOTO OR VIDEO IS YOUR MATERIAL AND YOU DO NOT WISH IT TO BE ON THE SITE, PLEASE EMAIL Us angelaeuyi@gmail.com AND WE WILL REMOVE IT IMMEDIATELY. Content created and maintained by King Angela Uyi.